[Lyrics] Erigga – “Kettle” (Story Of Okiemute)

1
2391
Erigga Kettle Story Of Okiemute
Erigga Kettle Story Of Okiemute

      Remove Vocals From Any Song Online

      Listen, Read and Enjoy Erigga Kettle lyrics for free.

      [INTRO]
      Oh na na na na, omo, its Paper boi, you know the voltage nah
      It’s your boi Erigga Paper boi & Graham D baba
      Omo E get wetin play when ah go Accra recently mehn!
      Ah nor fit yarn am, so ah gats put, ah gats express am through music you understand
      About my guy Okiemute



      [VERSE 1]
      Okiemute say like this he wan go join HK
      For Accra nothing dey him hand only 10k
      Eribaba believe me ah nor be JK
      Before ah waka we fit gather smoke your SK
      As we dey smoke ah tell am say na Akanuche
      E work for me nor mean say e go work for Uche
      He say Erigga lock up, who I wan follow pench
      Na my real guy beside, ah dey expect one cash
      On he way to Lagos he receive alert
      Family land na he sell the boi too get heart
      Enter Accra, he guys dey hail am Bossu
      He nor dey hustle every night steady bottle
      If dem wan cook for house nai him dey go withdraw
      Small small big Man for Accra don poor
      Nobody tell am around 10 o’clock for night
      Dem send am message lock gate, fling him things outside



      [HOOK] (GRAHAM D)
      Because E work for Mr A like that
      No mean say E go work ki for Mr B like that
      Because your friend travel go Ghana en make him money
      You think say if you travel you go make am too
      Use your sense waka no be leg
      The hustle wey we dey so na God abeg
      If not for the Streets, boiz for dey beg
      Na only God fit to change leggedis to Benz

      [CHORUS]
      Akaraka di iche
      Akaraka di iche
      Weluche gi ga ije oooh no
      Every mallam with him kettle
      And every body with him grace (X2)



      [VERSE 2 – ERIGGA]
      Habeg!!!
      According to brother Shaggy
      Oyibo talk say, patience na virtue is okay thank you
      The same kpo wey we smoke write better music
      Some other artiste smoke am wetin dem sing stupid
      Are you feeling me? Or should I repeat
      No be everybody be your man inside this street
      Boiz don fall person because of yeye pick up
      For my present police throw am for pick up
      Okiemute come area we ask am wetin sup
      For like 2 days ah swear my guy no gree talk
      Only to hear say he say where dem carry am go
      Dem give am knife shook mirror but nah him mama show
      He say he nor fit use him mama na him make am discharge
      Say around 10 o’clock for night he enter road come Lag
      Forgetting say everything wey dey happen for Accra, area don hear the real gist ah wan laugh belle scatter

      [HOOK] (GRAHAM D)
      Because E work for Mr A like that
      No mean say E go work ki for Mr B like that
      Because your friend travel go Ghana en make him money
      You think say if you travel you go make am too
      Use your sense waka no be leg
      The hustle wey we dey so na God abeg
      If not for the Street, boiz for dey beg
      Na only God fit to change leggedis to Benz



      [CHORUS]
      Akaraka di iche
      Akaraka di iche
      Weluche gi ga ije oooh no
      Every mallam with him kettle
      And every body with him grace (X2)

      [OUTRO]
      Omo nah so E just be mehn!!
      Which day here ah say Okiemute for Mega Chicken
      Ah dey call am he dey dodge (dodge)
      Ah nor understand this guy
      E nor dey, E nor dey
      Who naked nor dey shook hand for pocket
      Nah real matter be this mehn!!
      Another problem with our young boiz be say dem go dey compare their one step to another man one hundred step (real matter my guy)
      If you no get money no hide your face ooh
      Show your face make person help you
      Na so life just be (na so life just be)….

      Download Premium Beats For Free